
“You Go Post Soft Life But Your Mind Hard With Stress, You Dey Compete With People Wey No Even Know Say You Exist “- Charly Boy Sends Message To People Who Live Fake Life On Social Media
I dey look all these my fellow Instagram life people
Everything dey shine
But your real life dey dim
You go snap champagne
But na sachet water you drink after
You go post soft life
But your mind hard with stress
You dey compete with people wey no even know say you exist
See ehn
Validation no be food
E no go fill your stomach
E no go fix your life
You dey chase likes
But you no like yourself
You dey build image
But your reality dey crumble
Some of una don turn actor for your own life
Everyday performance
No day off
But when camera off
Na there truth dey wait
Listen well
No let social media pressure make you enter suffering
No let packaging kill your peace
Better small real life
Than big fake life
If you get 1k
Live like 1k
If you never make am
No pretend say you don arrive
Because life no be content
Na journey
And last last
When data finish
Na your real life go remain
So ask yourself
Who you be
When nobody dey watch?
Have a good week ahead.
It shall be Well with Us.
Credit: Charly boy|X
Email: elora.akpotosevbe@yahoo.com



What do you think?