
Man Shares Experience Dating A White Girl That Changed His Mindset About Relationship
When I first come Holland as a new student, I date one oyibo girl wey change my mindset about real relationship. From her place to my place na like €38, but she never ever ask me for transport money anytime she wan visit. One day sef she come with bag full of things. towel, perfume, cream and more. Wey she buy for me. She even tell me say the towel na from her mum wey say make she give me. On top that, she still give me €50 make I take buy food since I just arrive and never get job. Chai… oyibo girls 🥹. Dutch 🇳🇱 girls no dey stress you for transport money or dey disturb you for money for relationship.
I come say make I still connect back home, so I start to dey date one Nigerian girl. But this one, every time na emergency money matter 😀. If I manage send money today, in few weeks another emergency go show 🚨. E come dey look like one-way thing to me 👀. Anytime I talk say I no get money, her sweet messages go reduce like BTC price 😀. But once I send money, she go come dey do love video calls and all. I begin ask myself, this one na relationship or na MTN data subscription? E clear say the relationship tie to money. If I no date oyibo girl before, maybe I no go notice am.
Mind u i am not talking about wives here, and not saying u shouldn’t pay for a date night. But deliberately making money the foundation of relationship, that na the issue. Shey u see?, This na how many boyfriend-girlfriend relationships for Nigeria be, you must dey subscribe or pay bills before e go “sweet.” Person wey you no even born 🙄. Many Nigerian girls no dey comfortable with neutral relationship. You no go really understand wetin I dey talk until you don date oyibo girl 😔
Credit:Esheshare Peter|Facebook
Email: elora.akpotosevbe@yahoo.com



What do you think?